See am like this:
*1. You dey use phone to watch people, dem dey use phone to make money*
You dey watch TikTok from morning till night, you dey laugh, you dey comment. The person wey you dey watch, na him dey collect the money. If you turn that same time to post your own thing, you for don start to dey see small small money too.
*2. You dey learn, but you no dey do*
You don watch 100 videos on how to make money. You don save 50 posts. But you never post even 1. Learning without doing na waste. Even if e no fine, post am first, you go learn as you dey go.
*3. You dey look for who go dash you money*
Nobody go dash you money for phone. You must give value first. Teach person something, sell something, write something, show your work. Money dey follow value.
My own advice be this: No use your phone only to laugh. Use am to build something small today.
I still dey write my 1 article per day for Lodpost, I dey share am for WhatsApp and Facebook. E dey small small, but e dey enter.
Which one be your own? You dey watch pass, or you dey learn but you no dey do? Talk true fo
r comment.
---
You must be logged in to post a comment.