New Robot In Japan Fit Cook Jollof Rice And Sweep House At The Same Time

Follow
Listen to Article Listen to this article read aloud

Audio uses the voice available in your browser or device.

Japanese scientists don create history again after dem unveil a new humanoid robot wey fit cook food and do house chores at the same time.

 

The robot, wey dem call Momo-1, was built by Tokyo Robotics Institute for Japan. For the video wey dey trend online, the robot dey stir big pot of Nigerian Jollof rice with one hand and hold broom dey sweep house with the other hand.

 

According to the scientists, Momo-1 get Artificial Intelligence wey allow am to learn different types of food from around the world. Dem teach am how to cook Nigerian Jollof, Ghanaian waakye, and even Japanese sushi.

 

The lead scientist, Dr. Hiroshi Tanaka, talk say, We wanted to create a robot wey go help busy families. E fit cook, clean, and even watch pikin.

 

Nigerians for social media don start to react. Many people dey ask how much the robot go cost and when e go enter Nigeria market.

 

One lady for Facebook talk say, If this robot fit cook correct party jollof, I go buy am even if na 5 million.

 

Another person talk say, Japanese people sabi technology, but make dem no teach robot how to chop the jollof finish.

 

Scientists believe say in the next 5 years, this type of robot go dey for many homes for Africa because e go help reduce house work.

 

The company talk say the robot go cost around $15,000 dollars when dem start to sell am for 2027.

 

If you get this robot for your house, you go still dey cook or you go leave everything for am? Drop your comment.

More Articles by This Writer

Support the Writer

Enjoyed this article? You can support the writer with a voluntary donation.

Your donation supports Anthony Victoria

Minimum donation: $2.00   •   90% of the donation is allocated to the writer after the LodPost commission.

Comments

You must be logged in to post a comment.

About Author

2 Followers
1 Following
11 Articles
1 Likes