If you dey Port Harcourt and you dey broke, no be your fault. But if you stay broke when phone dey your hand, na your fault.
I go show you 5 side hustles wey dey pay for Port Harcourt for 2026. You no need capital. You just need phone and data.
1. WRITE ARTICLE FOR MONEY
Na this one I dey do now. You write article, people read am, website pay you. I don make $0.82 already, my target na $100. Website name na LodPost. You fit start today. Write about wetin you sabi, no need big English.
2. FOLLOW FOR FOLLOW GROWTH
People dey pay to grow their Facebook and TikTok. You fit help them grow by doing follow for follow, shoutout, and sharing. As your own page dey grow, brands go pay you to post for them.
3. SELL WHAT YOU SABI
You sabi cook? You sabi braid hair? You sabi repair phone? Post am for WhatsApp Status everyday. For Port Harcourt, people dey find who go do work for them everyday. Your status na your shop.
4. BECOME MIDDLEMAN
You no need get product. If your friend dey sell clothes, help am post am. If person buy, you collect your commission. Many boys for Port Harcourt dey make N5,000 to N10,000 everyday just from connecting buyer and seller.
5. DO SMALL TASKS ONLINE
There are apps and websites wey dey pay you to watch video, answer question, test app. E no go make you rich, but e go give you data money and small feeding money while you dey build your main hustle.
WETIN I LEARN
No hustle go pay you if you do am for 1 day and stop. I do my own for 3 days before I see first $0.82. If I stop for day 2, I for see $0.00.
Pick one hustle for this list. Start am today. Do am for 30 days. Come back tell me how much you make.
Comment I GO START TODAY if you go start today. Make I know who dey serious for Port Harcourt.
You must be logged in to post a comment.