Keke Price From Warri Main Market to Effurun, Enerhen Junction and PTI Today - November 2026 Update
Warri Main Market transportation kasala still dey affect keke price today.
After yesterday clash between keke riders, okada and police/agbero for Main Market, many passengers stranded for road yesterday evening.
This morning, I waka enter Main Market to check current keke price for people wey wan travel today.
*CURRENT KEKE PRICE FROM WARRI MAIN MARKET TODAY:*
- *Main Market to Effurun Roundabout:* N500 - N600 (Before na N400)
- *Main Market to Enerhen Junction:* N400 - N500
- *Main Market to PTI Junction (Effurun):* N600 - N700
- *Main Market to Jakpa Road:* N400
- *Main Market to Deco Road:* N300
- *Main Market to Estate:* N500
*WETIN CAUSE THE INCREASE:*
According to one keke rider wey I talk to for Main Market this morning, agbero don increase their daily ticket from N800 to N1200. Police self dey collect extra.
Na why many keke riders no wan work yesterday and price high today.
*ADVICE FOR PASSENGERS:*
If you dey go Effurun or Enerhen today, carry extra N200 for pocket because price fit change for afternoon.
I go update this list tomorrow morning.
You comot from Main Market today? How much you pay? Drop am for comment make others know.
You must be logged in to post a comment.