Na the 5 ways be this:
*1. I dey post market for people for my status*
Shop owners for my area dey give me their goods picture, I post am for status. If person buy from my status, dem dey give me small commission. Sometimes N500, sometimes N1000.
*2. I dey sell for WhatsApp groups*
I join buy and sell groups for my area. I dey post data, shoes, clothes, and foodstuff wey people dey sell. I no get shop, but I dey connect buyer and seller, I dey collect my own small gain.
*3. I dey write and share my Lodpost article for WhatsApp*
Every day I write 1 article, I share am for WhatsApp groups and status. When people click and read am, I dey earn small small. E no be millions, but e dey pay for my data.
*4. I dey do birthday flyer and advert flyer for people*
If person birthday reach, or dem open shop, I dey help dem design small flyer with free app for my phone. Dem dey pay me N500 or N1000. E easy, YouTube teach me am free.
*5. I dey help people run advert*
Some people get business but dem no sabi how to post am well. I dey help dem write correct caption and post am for groups. Dem dey happy pay me small money because customer dey come.
My advice be this: No dey use your WhatsApp only for gossip. Use am well, e fit dey put small money for your pocket everyday.
Which one among these 5 you fit start today? Tell me for co
mment, make I know.
You must be logged in to post a comment.